FUNNY 9JA STATUS
1. U dey do opening prayer 4 Night club, Na God
go slap ur mouth
2. U come back from Dubai dey form British
accent. Na rat go chop ur mouth
3. U be house boy u come dey play Rick Ross -
I am the Boss. 4 where na.....
4. U dey add water to egg say e go plenty when
u fry am Why u no add yeast join am...
5. U no go university, and u dey find ur name for
NYSC posting.
6. U come dey try read this one...sjhshgshflkljdjfl
a sorry 4 u.
7. Dem wan inject u with HIV infected blood u
come wear condom mtcheeeew u dey
mad
8. House dey born, you wan use gas do fire
extinguisher Hahahahaha..u don die.
9. As a girl u wear one undies for 2 weeks. Wetin
do u. #50 own dey nau.
10. Terry G's music dey inspire u unto which level
na
11. U carry candle dey look for where fuel dey
smell from continue u go soon see am
12. U call MTN to tell dem sey ur free browsin
cheat has stopped workin Lolzzzzzz.
13. When pastor talk say "Do somethin crazy for
the Lord" u come carry church offering run na
who wan hold u.